By: Yusuf Abuh
Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce on Monday say Lagos State Gornment go continue to scatter all illegal structures dem along di Lagos-Badagry Expressway.
Senior man Wahab drop dis informate, say, dem nor allow any kin person con scata work wey dem don dey do for di past three weeks, any illegal structure must go ground, so dat di environment go dey ok for everybody.
According to di gornment, dis waka of clearing illegal properties and gutters dey very important if Lagos must maintain dia doings as di number one city for Africa.