Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don carry Special Offences (Mobile) Court waka go different parts of di state to sensitize people on traffic and environmental laws.
Di programme wey hapun Friday for Lagos Safety Arena and areas like Oshodi, Iyana Ipaja, Ojota and Ikorodu na to teach people make dem obey law.
Dem focus on one-way driving, misuse of BRT lane and blocking public spaces.
State Attorney-General, Lawal Pedro SAN, say gornment dey serious to ensure justice for everybodi and correct every wrong behaviour.
Written by: News Author
LAGOS STATE GOVERNMENT Lagos traffic laws Mobile court Lagos Traffic enforcement Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025