Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Muslim Community of Lagos State, MCLS, don raise concern say, di way gorment take dey sideline Muslims for political appointments and governance for di state, say e nor dey sweet dem for belle.
Di group tuk dis one for last Saturday during dia first General Assembly wey dem hold for Lagos State Secretariat Mosque Hall, Alausa, Ikeja.
MCLS lament say Muslims dey excluded especially for education sector, and call say, make gornment recruit Arabic and Islamic Studies teachers for public schools.
For dia resolution, di group declare say dem no go support any political party wey present non-Muslim candidate for di 2027 Lagos governorship election.
Written by: News Author
Lagos Muslims LAGOS STATE GOVERNMENT Muslim Community Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025