Lagos

“Lagos NOA Don Start Two-Week Campaign”

todaySeptember 11, 2025 6

Background
share close

National Orientation Agency (NOA), Lagos State don kick off one two-week campaign wey dey aim to wake citizens mind make dem sabi government policy, national identity, safety, values, and development. Di State Director of NOA, Dr. Mustafa Adedeji Tukur, wey yarn dis one for press conference wey dem do for di agency headquarters for Dopemu, talk say as part of di program, dem go waka go schools, motor parks, markets, jam traditional rulers, do road show and town hall meeting, to ginger people body on top national values. E still talk say dem go meet other important people wey matter for society, to raise awareness on top di matter dem. E beg media people and all Nigerians make dem support the program make e for succeed well well. For message wey dem send come di program, NOA Director-General, Mallam Lanre Issa-Onilu, wey Mr. Segun Alao, Deputy Director for Environment, Climate and Energies, NOA Headquarters, Abuja, represent, explain say di campaign go shele for all di states at once across di country. E talk say di campaign na special one because e go reach Federal Capital Territory (FCT) and all di 774 local government areas for Naija.

E yan say, “based on recent survey and field reports, e don show say gbalaga still dey for awareness, bad habits still full ground, and fake news dey fly up and down, all dis kain things dey threaten our unity, safety, and progress for this our country.” E come add say, “We go promote sharp eye and alertness. Na when citizens sabi wetin dey happen and put body for wetin concern dem, na so democracy dey shine. Our communities dey safer when people dey alert and cooperate. Our pikin dem dey grow well when correct values guide dem. Our culture and heritage go last well if we respect and carry our national identity and symbols with pride. Our work and daily hustle go dey safe if we prepare well before wahala like natural disasters land. If we join hand together, the values wey we dey talk go turn to the values wey we dey live.” E come list five key areas wey dem go focus on for di campaign, National enlightenment on top government policy, programmes, and activities, flood wahala, how to reduce am and prepare well for any disaster, national security awareness, make people sabi how to protect themselves and their community, national values reorientation, especially for students, make dem no dey join those extreme sign-off practices wey no make sense, Nigerian identity project and national symbols campaign, make people sabi and carry our identity and symbols with pride

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app