By: Emmanuel Ariyo-David
Any kind person wey dey play with Lagos State Gornment, dey on along tin oh, like dis environmental law kramp some pipo for Oshodi.
Magistrate court for Bolade, Oshodi don sentence 13 pipo to three months imprisonment each say dem go throw dia dirty yayaayaa for area, wey dey illegal .
Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, naim dey dey konfam say all 13 suspects plead guilty to di charges.
Dis move na part of government effort to make sure Lagos remain clean and safe.