Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
People wey dey live and work for buildings wey dey near one construction site for 28 Saka Tinubu Street, Victoria Island, Lagos, don beg Lagos State Government make dem come intervene sharp sharp. Dem talk say the ongoing construction project dey pose serious danger to people life and property. The building, wey be multi-storey and handled by Diplomat Homes Limited, no dey follow correct safety standards, according to wetin the residents talk. Dem say dem never see proper protection for the site, and because of that, plenty damage don happen to motor and buildings for the compounds wey near the area. Dem talk say the developer get connection with one big traditional ruler from South West, no put basic safety things like barricade, safety net or any form of protection shield. Because of this, things like wood, stone, and other materials don dey fall from up enter people compound. E don break wall, scatter window, destroy ceiling and even damage cars.
But na no be only property wahala dey worry dem the residents say dem fear say if government no act fast, serious injury or even death fit happen. One person wey dey live near the area talk say, “Na only God grace say nobody don collect something for head up till now.” Dem come still dey ask why government agencies wey suppose dey watch over this kind thing never talk or do anything especially the Lagos State Building Control Agency (LASBCA) and the Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab. Dem say the agencies suppose act now before the matter turn full-blown disaster. The people wey don suffer from the thing dey insist say dem want urgent action make dem force the developers to follow safety law well well.
Written by: News Editor 1
LAGOS RESIDENTS Lagos state PUBLIC SAFETY
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025