PUBLIC SAFETY

6 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Say No Mercy For Jaguda Boys

By: Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don drop micro soft word for democracy day, say make dis terrorists, bandits and kidnappers, nor too worry bodi, dat di gorement and security dey come for dem with full force. Im knack dis one for im Democracy Day speech wey e deliver on Friday to mark Nigeria 27th uninterrupted democracy anniversary. Baba seyi burst mehn bolobolo when im say, torrist killings […]

todayJune 12, 2026 8

south west

Police Clear Air Say No Security Threat Or Panic For Ondo LGA

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don clear di air say no shake-up, security threat, or any bad tin inside Odigbo Local Government Area at all. Di command image-maker, DSP Abayomi Jimoh, yarn dis one inside statement on Tuesday say all di sharpman doings and security check wey dem do show say di area dey clear. Because of dis one, di Commissioner of Police for di state, Felix Ohagwu, […]

todayJune 3, 2026 7

Lagos

Lagos Fire Service Call For Joint Action As Dem Plan Big Conference For Ikeja

Lagos State Fire and Rescue Service dey call for beta join-hand action for di whole country to stop fire disaster before di 2026 Lagos International Fire Safety Conference (LIFSC) start. Di big meeting, wey dem tag LIFSC 3.0, go hold from July 6 to 8 inside Ikeja, and di main tuk na how to stop fire for inside buildings and market places. Oga kpata-kpata for Lagos Fire Service, Margaret Adeseye, […]

todayMay 27, 2026 9

Lagos

Staff Jump From Storey Building As Fire Don Scatter UBA Lagos Island Branch

The United Bank for Africa, UBA, branch for Lagos Island don catch fire now. Nobody sure wetin cause the fire yet, but for one video wey dey trend for social media, some bank staff dem dey try jump down from the storey building. For the video, the workers dem dey try escape through the windows. As this report dey come out, emergency responders never give official statement on the matter.

todaySeptember 16, 2025 63

Lagos

Lagos Police Ban Egungun Parade, Issue Strong Warning

Lagos State Police Command don order say all Egungun masquerade festival activities must dey limited to only approved outing points and celebration venues across the state. The order wey the Command’s spokesperson, CSP Benjamin Hundeyin, announce on Sunday, na because of reports say some rival groups dey fight and cause wahala during the traditional festival for some parts of Lagos. According to the police, this restriction na to protect lives […]

todaySeptember 2, 2025 70

Lagos

Lagos People Don Shout Say Ongoing Construction Dey Put Their Lives For Danger

People wey dey live and work for buildings wey dey near one construction site for 28 Saka Tinubu Street, Victoria Island, Lagos, don beg Lagos State Government make dem come intervene sharp sharp. Dem talk say the ongoing construction project dey pose serious danger to people life and property. The building, wey be multi-storey and handled by Diplomat Homes Limited, no dey follow correct safety standards, according to wetin the […]

todayAugust 29, 2025 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds