By: Jolayemi Olajide
Lagos State Police Command don assure residents saydem mout oh unto di aproko of bandits attacking or kidnaping school children for di state, despite threatening notice wey circulate on Monday.
Di Command, through Police Commissioner CP Tijani Fatai, immediately order security to mout di affected areas, schools and other important places.
Oga commissioner dey insist say Lagos dey safe and any bandit, kidnapper or anybody wey wan cause fear and panic for di state go face di full weight of di law.