Lagos

Lagos Taskforce Begin Clear Alaba Rago, Clear Illegal Traders

todayJune 30, 2026 3

Background
share close

Lagos State Taskforce don begin park pipo comot for Alaba Rago area along Mile 2 – Badagry Expressway after dia 72-hour notice wey dem give illegal traders and occupants expire on Monday.

Dem dey remove street traders, funny shops and every structure wey block road, pedestrian walkway, road median and setback wey break Lagos environmental and town planning law.

Chairmo of the Taskforce, CSP Adetayo Akerele, fry mouth, konfam say gornment first tell di traders make dem comot peacefully before di deadline.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds