Lagos Taskforce

6 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Lagos Taskforce Vow To Deal With Road Blockers, Okada

By: Ayobami Dada Lagos Taskforce don warn road users and anybody wey dey block public roads or do things wey fit put people life for danger say enforcement go increase for di state. Di Taskforce Chairman, CSP Adetayo Akerele, talk dis one on Wednesday for di agency 2026 Stakeholders’ Engagement Programme wey hold for Safety Arena, Bolade-Oshodi, Lagos. Akerele say dem go enforce di law against okada riders wey dey […]

todaySeptember 17, 2026 14

Lagos

Lagos Taskforce Gbab 33 Suspects, Recover Drugs And Dangerous Weapons

By: Yusuf Abuh Lagos State Environmental and Special Offences (Enforcement) Unit don go kramp 33 suspected jaguda criminals on Monday for different areas of Lagos Island and Lekki corridor. Di Agency tuk tuk person, Raheem Gbedeyan, naim sorosoke dis mata, say di pipo wey dem gbab include area boys, pipo wey dey sell  drugs, drug addicts, illegal okada riders, ticket touts and other jadugas, while officers recover Tramadol, Indian hemp, […]

todayJuly 28, 2026 22

Lagos

Lagos Taskforce Begin Clear Alaba Rago, Clear Illegal Traders

Lagos State Taskforce don begin park pipo comot for Alaba Rago area along Mile 2 - Badagry Expressway after dia 72-hour notice wey dem give illegal traders and occupants expire on Monday. Dem dey remove street traders, funny shops and every structure wey block road, pedestrian walkway, road median and setback wey break Lagos environmental and town planning law. Chairmo of the Taskforce, CSP Adetayo Akerele, fry mouth, konfam say […]

todayJune 30, 2026 14

Lagos

Lagos Attorney-General explain how  Police Take Dey Spoil Taskforce Work

By : Jolayemi Olajide Lagos State Attorney-General and Commissioner for Justice, Lawal Pedro, don accusat di Nigeria Police, say, dem ma dey put sand, sand for di lagos state task force garri, refusing to  fight against land grabbers. Im yarn dis one  give tatafo pipo  for Alausa, on  Sunday. According to di  Attorney-General, say di police suppose work wit  state Special Taskforce and dat  police refuse to follow dia order. […]

todayMay 25, 2026 23

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Five “Omotaku” Wey Dey Extort Motorists

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest five street boys wey dem dey call “Omotaku” for Aboru–Abule-Egba area of Abeokuta Expressway on Monday. Di suspects, wey include Alade Olarewaju, Oluwadamilare Alabi, Sunday Idowu, Rabiu Ibrahim, and Raji Yusuf, say dem catch dem, afta one motorist call di Taskforce say dem wan extort am. Chairmo of di Taskforce, CSP Adetayo Akerele, yarn for statement say dem bin dey even track […]

todayMarch 24, 2026 26

Lagos

Lagos Taskforce Deny Say Dem Nor Do Bribery And Corruption

By: Esther Ayoola Lagos State Environmental and Special Offences Taskforce say dem nor collect any bribe to release motor wey dem seize. Di agency tuk, tuk, Abdulraheem Gbadeyan, ni tuk dis on Thursday for Lagos, afta one online report accuse dem wrongly of bribery and corruption. Him explain say all dia operations dey follow law, and offenders dey charged to court if necessary. Gbadeyan also defend dia chairmo, CSP Adetayo […]

todayMarch 13, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds