Lagos State Gornment don carry mata for head dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal.
Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety.
Na di oga kpatakpata, Director-General of di Lagos State Safety Commission, Lanre Mojola, naim use im yamchop mouth porporly dis mata, say now, dem go dey involve, for every stage of building design, construction, operation and maintenance.
According to am, say na base on say dem bin dey thorway face for di mata naim make project pipo build tins wey dey collapse anyhow dat, as Lagos dey grow fast, gornment need stronger safety standards to reduce building collapse, fire outbreaks and workplace askidents.