Sports

Lamine Yamal Put Pressure For France Body

todayJuly 14, 2026 10 1

Background
share close

As di 2026 World Cup don enter Semi Finals, Spain and France go play by 8pm dis night, na so tension dey full bodi.

But Spanish wonder boy, Lamine Yamal no send either tension or pressure as e go post picture of di 5-4 victory wey Spain knack give France for 2025 UEFA Nations League Semi Finals.

Yamal drop dis post for him Instagram story on Tuesday to remind France say everywhere choke and make dem also see am as threat against dia defense.

And for interview with tori pipo,  he sti fry mouth put say na only Spain fit beat France and dat dis na di most important match of him career.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds