Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos Waste Management Authority don announce new way, wey dem wan take manage dirty for Apapa-Iganmu area, say na operation show your Payment Receipt.
Dis dem disclose for statement signed by oga LAWMA, Muyiwa Gbadegesin, con post for Lagos State Gornment’s official social media platforms on Monday say make all residents and business owners readi dia assigned Private Sector Participant waste operators.
Oga LAWMA say, di exercise go hellep stop anyhow waste management and hellep dem find houses wey no get proper waste collection arrangement.
According to Muyiwa, Dem go dey do routine checks for both residential and commercial buildings to make sure everybody dey follow di rule.
Written by: News Author
Lagos Sanitation LAGOS WASTE MANAGEMENT LAWMA reforms Waste disposal Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026