By: Esther Ayoola
Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don arrest one man for Lagos Island early Tuesday mor mor, say im thruway dirty wey smell reach gorment house.
Say dis operation na part of dia effort to stop pipo wey dey throw dia dirty anyhow for di area.
According to a statement for di lagos state gorment official website, di man, wey dem identify as Muritala Suleiman, 42 years old from Zamfara State, say, dem gbab am around 1:31 a.m. as e dey dump waste for Tinubu Square.
LAWMA tuk say dem wan make sure to stop all illegal dump points, to hellep Lagosians live safe life.