National

Lawyers Demand Open Trial For Delta Police Officer Wey Go Allegedly Kpai

todayApril 29, 2026 6

Background
share close

By: Esther Ayoola

Human rights group Avocats, Sans Frontières France (AKA Lawyers Without Borders) Don wire call to wi Federal Gornment and Naija Police Force to ensure transparency and public prosecution over alleged kpai, a 28-year-old criminal suspect, one Mene Ogidi.

Di group Country Director, Angela Uwandu-Uzoma-Iwuchukwu, explain, say di incident happen on April 26, 2026 for Effurun, Delta State, where ASP Nuhu Usman allegedly shoot di suspect wey dey under Effurun Area Command.

She add say reports and viral video show say di officer do unlawful killing, wey dem describe as total collapse of due process and violation of right to life under Section 33 of di Constitution.

ASF France say dem dey demand justice and proper investigation and dat make di officer go face public prosecution for wetin happen.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds