By: Esther Ayoola
Lebanon Health Ministry dey cry wetin nor good oh say, Israeli attacks for southern Lebanon don sti go kpai 51 pipo, including two medical workers, as dem carry out strikes for Qalawiya and Tibnin for Bint Jbeil district.
Dem accuse Israeli forces say dem violate international law by targeting health centres and emergency workers, even with US-brokered ceasefire.
According to di ministry, since March 2 when new military operation start, over 2,846 pipo don kpai, while UN say at least 103 medical workers don lose dia lives and 230 injure from more than 130 strikes.
Emergency responders for Tyre, like Lebanese Civil Defence head Ali Safiuddin, say dem dey work under constant fear because attacks sti dey hapun despite humanitarian rules wey suppose protect dem.