Sports

Liverpool Use Late Drama Take Humble Atletico Madrid As Dem Open Their Champions League Waka For Anfield With Victory.

todaySeptember 18, 2025 5

Background
share close

Alexander Isak finally show face for Liverpool, but e be like say Arne Slot boys go vex as Atletico come back from 2-0 down equal am, until Van Dijk nod better winning goal for stoppage time. No be di new boys, na di old superstar wey show levels, Mohamed Salah run things as Premier League champions tear Atletico 2-0 within six minutes. Salah free-kick bend enter net after e touch Andrew Robertson, wey confuse Atletico keeper Jan Oblak just four minutes in. Not long after, Salah run one sweet one-two with Ryan Gravenberch before he calmly slot di ball inside net. Atletico drag one back for first-half stoppage time as Marcos Llorente sneak low shot under Alisson, while Liverpool dey shout say na offside.

Tired Isak comot for 58 minutes as Liverpool still dey control di game. Salah suppose don add third goal, but him shot nack post right in front of Di Kop after better setup from Florian Wirtz. Llorente, wey score two goals when Atletico carry last-16 Champions League win for Anfield in March 2020, do am again with volley wey bend for Alexis Mac Allister nine minutes to full time. Liverpool no gree lose as dem dey do for dia four Premier League wins dis season, with time nearly finish, Van Dijk jump high to head corner goal and make Di Kop burst with joy. For di gbege wey follow after, Atletico coach Diego Simeone collect red card after e jam supporters wey dey behind im technical area.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app