By: Rilwan Agbomeji
French Presido Emmanuel Macron don vex oh, scata body for ground dey vex say violent protesters wan brin hin country down.
Hin porporly dis mata Inside television tok Sunday, Macron promise say all di pipo wey dey destroy property, say if hin kramp dem ehn, dem go pay
Di country Interior Ministry tok say police gbab almost 2,400 pipo on Saturday alone, as about 1,000 police officers wunjure for di venue, naim be say dose pipo own mind go dey.
Macron come explain say government go divide pipo where get real problem comot from those bad eggs wia just want smash, destroy, and steal things.