Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Consumer Protection Agency (LASCOPA) don warn Lagosians say make dem shine eye well well, as Easter dey come, say chances of people to cheat and sell bad market dey high for dis period.
For statement wey dem drop for dia X page on Thursday, General Manager, Afolabi Solebo, talk say make consumers stay sharp as buying and selling go increase.
E say make people careful because price fit shoot up, some traders fit sell fake, expired or dangerous goods, and some promo fit just dey deceive.
Solebo still advise make residents check well-well di quality and originality of anything before dem buy am.
Written by: Ridwan Agbomeji
EASTER FAKE PRODUCTS Lagos LASCOPA
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026