By: Yusuf Abuh
Oyo State Govo, Seyi Makinde, don call for independent investigation into di abduction of children and teachers wey hapun for Ahoro-Esinle and Yawota communities for Oriire Local Gornment on May.
Di govo tok dis one for statewide broadcast on Monday for Ibadan after dem hand over 46 children and teachers wey security operatives rescue from bandits.
Makinde say international human rights and accountability bodies, including agencies under di United Nations, suppose help investigate di matter.
According to am, di way di kidnapping take hapun na serious suspect and e need proper independent probe.