By: Esther Ayoola
Oyo State Govo, Seyi Makinde, don inaugurate Oyo State Council of Obas and Chiefs afta 15 years, wit Olubadan of Ibadan, Oba Rashidi Ladoja, as di first chairman.
Di event happen for House of Chiefs, Secretariat, Ibadan, but Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, no show face for di inauguration.
Govnor Makinde tuk say di chairmanship go dey rotate between Olubadan, Alaafin and Soun of Ogbomoso, say na agreement wey dem reach for meeting wit di three monarchs.
But same Thursday, Alaafin media aide, Bode Durojaye, release statement wey counter di govnor tuk.
According to di Alaafin, no such meeting ever happen between am and di govnor.