Listeners:
Top listeners:
 play_arrow
		play_arrow
		KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Oyo State Police Command don confirm say dem don arrest one man wey im name be Lawal Faruq, wey allegedly burn im ex-lover, Omolola Hassan, after their relationship scatter. Di incident bin happen for one military barracks for Ibadan, Oyo State capital. One counterinsurgency expert, Zagazola Makama, wey yan for X (former Twitter), talk say di guy claim say him and di babe don swear say dem no go ever break up. But as di love cast, di guy vex come pour petrol for di girl body, light fire burn am. Na di soldiers wey dey barracks rush come quench di fire sharp sharp and carry di girl go Yawiri Hospital, Akobo, before dem arrest di suspect.
Makama talk say di suspect still dey for custody as police dey carry investigation go front. Di Oyo Police PRO, Adewale Osifeso, confirm di matter but talk say investigation still dey go on. Cases wey get to do with lovers wey dey harm each other don dey happen steady for Naija. For July 2025, one Uniport student, Cynthia Chukwundah, burn her boyfriend after quarrel about belle, di guy later die. Again, for January 2023, one man strangulate him babe and burn her for Rivers State because of cheating wahala. And for April 2023, another man for Ogun State burn him ex-babe house as she no gree come back to di relationship. All these gbege na part of di domestic violence palava wey dey increase for Naija because of emotional, money and mental stress.
Written by: News Editor 2
Man burns ex-girlfriend in Oyo Woman set ablaze by ex-boyfriend
 
		
			 
		
			 
		
			 
		
			 
		
			We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025