By: Esther Ayoola
Football Supporters Europe (FSE) and Euroconsumers don file case on Tuesday give European Commission against FIFA over high ticket price for 2026 World Cup.
Dem tuk say ticket for di tournament wey go happen June 11 to July 19 for US, Canada and Mexico too cost, and accuse FIFA say dem dey use monopoly power control sales.
FSE say FIFA impose unfair and confusing buying conditions for fans, wey no go fit happen for normal competitive market.
Dem add say cheapest final ticket now start from $4,185, wey pass 2022 Qatar own wella and far higher than Euro 2024 final ticket wey be about 95 euros.