By : Jolayemi Olajide
United State Secretary of State, Marco Rubio don bring new proposal for relationship between United States and Cuba, as e talk say dem fit give $100 million food and medical support.
For video message wey e send go Cuban people on Wednesday, Rubio talk say dis plan fit open new door between Washington and Havana as di money go hellep solve food and drug wahala wey dey disturb di country.
But e still talk say na Cuban leaders cause most of di gbege, say dem dey mismanage everything and na dem bring shortage of light, fuel and basic needs wey pipo dey face every day.