National

Motorists, Commuters Hail Ogun Government For Repairing Abeokuta–Sango-Ota–Lagos Expressway

todaySeptember 3, 2025 3

Background
share close

Motorists and passengers don hail Ogun State Government for the ongoing repair of bad parts of Abeokuta–Ifo–Sango-Ota–Lagos Expressway. Governor Dapo Abiodun launch the road reconstruction on August 23, 2024, with 18 months to complete am. Areas like Brewery, Obada, Itori Junction, and Lafarge Cement Factory for Ewekoro don already see better work and dem don open am back to traffic, wey don bring serious relief to people wey dey use dthe road. Five construction teams dey work at the same time for Olomore, Midgad/Metroxide, Papalanto Junction, Owode, and Toll Gate side. For many areas, dem don already finish earthwork, stone base, and drainage, while dem don start dey lay asphalt.

The Olu of Itori, Oba Abdul Fatai Akorede Akamo, thank the governor for taking action, say the road dey very bad for long, and despite say na federal road, Governor Abiodun still take am serious. Transporters and residents also dey happy with the quality and speed of work. One driver, Opeyemi Akindele, talk say accidents and traffic don reduce well-well and movement don smooth now. E beg make dem build trailer park near Lafarge side to stop trailer from blocking road. People from Papalanto like Ololade Anjolaoluwa and Akande Michael talk say the road don already change and dem thank Governor Abiodun for remembering dem, while dem still beg make dem finish the work as planned.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app