OBODO NAIJA

MURIC Tell Adeleke Make E Begin Pack Comot Gornment House

todayJuly 27, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

Muslim Rights Concern (MURIC) don tell Osun State Govo, Ademola Adeleke, make e begin prepare to leave Gornment House, say plenty people for di state don reject im administration.

For statement wey Executive Director of MURIC, Professor Isiaq Akintola, sign on Monday, di group accuse Adeleke say e deceive Osun people with promises wey no match wetin dey happen for ground.

Akintola also claim say one flyover wey govo commission for Osogbo don begin show signs of damage just three weeks after dem open am to di public.

Di group further allege say Adeleke administration dey favour people from Ede, im hometown, more dan other parts of Osun State, and call on di govo to address di complaints of residents across di state.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds