Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Kofoworola Olayinka
Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground.
Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty pipo.
According to reports, 2Baba and Annie meet around 1999/2000 for Lagos wen dem start as padi. By 2004, Annie appear for 2Baba popular “African Queen” video, and report say dia friendship don already turn relationship. But make nobody tink say dia love story na beta road.
Dia relationship get breakups, come-back and other relationship enter di picture, but somehow somehow, dem still find dia way back to each other.
For 2008, dem welcome dia first pikin, Isabella, after that one, 2Baba propose to Annie, and dem legally marry for Lagos on May 1, 2012.
Traditional marriage follow for Akwa Ibom in 2013, before dia big church marriage for Dubai later dat same month.
Later, dem welcome dia second pikin, Olivia.
For many Naija pipu, 2Baba and Annie show dat kind love wey pipo dey tok as: “We don suffer together. We don grow together. Now we don marry.”
And wen dem promise to love each other again for dia 10th wedding anniversary for 2022, plenty pipo believe say, after all di palava, dis love still get strength to survive.
But sometimes…
Na only pipu wey dey inside di marriage go sabi how serious di marriage don become.
When Di Palava Start To Reach Social Media
One of di biggest public gbege happun for September 2021, wen Annie come outside with her full chest, for social media and she tok say 2Baba dey spend many night with hin former partner, Pero Adeniyi, for dia family trip and e vex her like mad.
Na so social media carry di matter for head, audio travel, people support who dem love, Family members tok dia own.
But make we put am straight: “Na blame dem make, dem neva prove say na true”.
Still, di whole mata prove some serious gbege around trust, jealousy, family gbege and di pressure wey fit come wen private marriage mata enter social media.
For Annie, to marry a man wey get pikin from anoda woman also come with hin own palava, for plenty pipo wey dey watch from outside, wan question begin dey ring:
Shey you fit truly love pesin and still struggle with di baggage wey come togeda with dia past?
Den January 2025 Come
After years of public gbas-gbos , January 26, 2025 bring di update wey shock plenty pipu.
2Baba yarn say im and Annie don separate “for a while” and tok say divorce process don start, at first, pipu no believe am.
Pesin for Instagram con mention say hin account don get hacked pipu begin wonder. But 2Baba come out after say nobody hack im account na him, na im talk am.
Na so di marriage end.
Wetin Really Cause Di Divorce?
Dis na where we gats comot emotion and face correct facts so dat we no go lost. We neva hear any ogbonge reason wey we fit point to say, “Na dis one scatter dia marriage.”
For July 2025, 2Baba hinsef use im mouth tok say dem don give di relationship dia best, but e no dey work again. He no give di public di full gist unto wetin play, so like dis di divorce mata no clear to anybody ooooo.
How Natasha Take Enter Di Tori
After di scatter-scatter don reach di public of di eye, 2Baba later enter anoda relationship with Natasha Osawaru.
Na so social media tori pipu begin ask questions, say shey na Natasha cause di divorce?
If we know we go tell you, but di available record no establish dat as fact say na Natasha spoil 2Baba and Annie love life .
Wetin we know be say 2Baba and Annie marriage don already reach di level of no return before him relationship with Natasha.
And by July 2026, both Annie and 2Baba dismiss social-media tok say dem don reconcile.
So, if love fit start with forever, survive years of memories, children, sacrifices and plenty storms, yet still reach a point where two pipu go dia separate ways, shey true love really dey exist?.
Because we just dey mistake deep feelings, good memories and strong attachment for di kind of love wey truly fit last forever?
Written by: Rilwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds