By: Mariam Ajayi
Nigerian Air Force don increase air operation against terrorist, bandits, kidnapper and oda criminal across di North-West, especially Sokoto State.
NAF tuktuk pesin, Air Commodore Ehimen Ejodame, talk dis on Monday for Abuja, say di stronger air presence na to support joint security operation.
Ejodame say di operation go helep security forces use air surveillance to find criminal group wey dey hide for difficult area and stop dem from moving freely.
Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Aneke, say NAF go continue to use air power and better intelligence to put pressure on criminal element and help ground troop take control of di area.