Lagos

NAFDAC Burst Fake Malaria Drugs Worth N1.2 Billion For Lagos

todaySeptember 12, 2025 5

Background
share close

As part of the fight to stop fake, adulterated and expired drugs wey full the country, NAFDAC don seize fake malaria drugs wey worth N1.2 billion. As he dey talk to journalists, the Director of Investigation and Enforcement, Martin Dotun, para say even with all the effort wey NAFDAC dey put to clear fake drugs from the country, some bad belle traders still dey import counterfeit drugs come Nigeria, make innocent people wey no know anything dey buy and use am. According to Dotun, the fake and expired drugs wey dem import hide inside motor spare parts, and na for Lagos NAFDAC seize all of them. “As part of how dem dey try confuse our people, the importer tell NAFDAC officials wey catch dem for Oshodi-Mile 2 Expressway say the vehicle get only spare parts, but when enforcement people follow the vehicle go the place wey e dey go, dem discover say the drugs hide among the supposed spare parts.” These ones na part of follow-up operations wey we start some months ago, when we raid Aba, Onitsha and Idumota markets and seize plenty drugs. I fit assure you say we no go stop until we finish the work wey President Tinubu and NAFDAC DG, Dr Mojisola Adeyeye give us, to save Nigerians from the wahala of fake drugs. “You fit imagine how many people go suffer if we no quick seize these drugs, especially as dem get different fake tags with different names, wey fit confuse people make dem buy am as real anti-malaria drugs.” “We no go slack at all until we finish this kind thing,” he talk. Before this one, the officer wey lead the operation on August 29, 2025, Florence Uba, talk say the drugs wey dem seize get plenty different labels.

“We see the long truck wey full with supposed vehicle spare parts. But I decide to follow the vehicle go the warehouse where dem dey unload the spare parts. Even though dem try fool us say na only spare parts, we still see say inside the cartons, 277 of them, na drugs dem carry.” “When we check well, we see say dem give fake declaration as the cartons get different names. The 277 packs get different names, and the sachets of the drugs get two different names. Until we do Laboratory test, we no yet know wetin exactly dey inside those sachets.” “We get here wetin dem call Diclofenac potassium enteric coated 50mg, Arthemeter/lemufathrine 80/480 mg. Each tablet suppose get Arthemeter/lemufathrine 80/480 mg, but we go still run lab test to sabi true tin.”

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app