With a heavy 4–0 win over dem neighbours, the Super Eagles don secure play-offs berth, while Gabon confirm say dem second for Group F after 2–0 win against Burundi. Ivory Coast top their group after beat Kenya. For other matches, DR Congo clinch qualification with 1–0 win over Sudan to end second behind Senegal in Group B. Cameroon waka enter play-offs too after dem finish second behind Cape Verde in Group D.
For di CAF Play-offs, Naija go face Gabon’s Panthers for “first semi-final” on Thursday, November 13, while Cameroon go meet DR Congo on Friday, November 14. The winners go jam each other for “final” on Sunday, November 16, and di winner go advance to Intercontinental Play-offs wey dey scheduled for Guadalajara and Monterrey, Mexico in March next year, according to NFF.