By Ebi Oboko
Di Naija National Assembly to clear mehn doubt, say dem don dey arrange to show the general public di part of di Tax Acts wey dem say small confusion dey untop, say no wayo anywia.
Director of Information, Bullah Bi-Allah, yan yesterday, say dem don direct the Clerk to release certified copies of di bills wey President Bola Tinubu don sign.
Di copies go get certificate pages, so dat, public fit check and confamate di documents.
Di decision na response to public call for transparency and to clear any doubt wey dey about di Tax Acts.