Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Actress Nancy Iheme don drop her mind for Instagram as di wahala between Regina Daniels and her husband, Senator Ned Nwoko, dey hot. Even though she no call anybody name, her long post clear say e relate to di gist, as she warn young women make dem shine dia eye before dem marry older men. Nancy talk say many old men sabi play smart and women wey wan marry dem gatz use sense and strategy. She write say, “You no fit marry old man without calculation, especially when you sabi say im be polygamist. You no go climb that kind age gap come dey collect crumbs.”
Nancy still advise ladies make dem no dey see marriage like poverty-alleviation programme, as some old men dey use money take control dia wives. She talk say to marry old man no be work for faint-hearted woman at all. She come urge women make dem always put dia happiness first and waka commot from any relationship wey no dey favour dem again.
Written by: News Editor 1
Nancy Iheme Regina Daniels Senator Ned Nwoko
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025