Presido of Nigeria association of Nigerian Student, Akinteye Babatunde, don cut chain oh , say why di Vice-Chancellor of Federal University Oye-Ekiti (FUOYE), Prof. Abayomi Fasina, go suspend di school SUG Presido, James Adio.
Babatunde tell pipo on Friday say di student body kick completely against how di school take suspend and push di SUG leader for corner.
Di Vice-Chancellor come explain wetin cause di suspension, say Oga SUG presido go migrimor and di video con leak.
Prof Fasina promise say di school Senate go sit down look di mata again next week Wednesday to settle di mata
Prof. Fasina still give order say make dem investigate di pipo wey go leak di suspended SUG President private information give public, and any person wey dem catch go face di law.