obodo oyinbo

National Assembly Don Stop Trips Go South Africa

todaySeptember 11, 2026 4

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

National Assembly don tell senators, members and workers make dem no travel go South Africa for official work until further notice.

Dem also say make nobody from National Assembly join any meeting or programme wey South Africa organise for lawmakers.

House of Representatives spokesman, Akin Rotimi, talk say dem take dis decision because of reports say Nigerians and other Africans still dey face attack and serious wahala for South Africa.

Di National Assembly say dem go continue with di boycott until further notice, as dem dey worry about how Nigerians dey treated for South Africa.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds