By: Esther Daniel
NBA President, Mazi Afam Osigwe, don say security operatives and foreign observers go monitor di association election to make sure say di process dey transparent and fair.
E talk say dem invite di independent observers so dem fit give objective report after di election.
Osigwe also clear fear of election rigging and deny allegation say e dey support or impose any candidate.
Di three candidates wey dey contest to succeed am na Olumuyiwa Akinboro (SAN), Lateef Omoyele (SAN), and Oyinkansola Badejo-Okusanya (SAN), wey be di only female candidate.