Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don burst one drug party wey happen for Proxy Night Club, Victoria Island, Lagos, on Saturday night, arrest over 100 people, including di club owner, Mike Eze Nwalie Nwogu aka Pretty Mike. Di NDLEA officers wey don already dey inside di party since 11pm scatter di groove around 3am Sunday morning, after dem get correct intel say na drug party dey go on. Dem recover cartons of Loud, laughing gas and other illegal drugs for inside di club and store. Meanwhile, NDLEA also burst one major cocaine smuggling plan wey involve 70 parcels of cocaine wey dem hide for cocoa butter cream containers wey dey go London. Di cocaine weigh 3.6kg and dem catch three suspects, Lawal Olakunle, Deborah Ogunmuyide and Mutiu Adebiyi, for Lagos during follow-up arrest wey last two weeks.
For other states, NDLEA operatives continue to scatter drug matter across Nigeria. One Lesotho man, Lemena Mark, wey wan export 103.59g of methamphetamine hide inside Diabeta herbal coffee to Philippines, don land for wahala as NDLEA catch am for Enugu Airport. For Kwara, dem arrest Umar Abubakar with 21,950 tramadol capsules hide inside water heater. For Taraba, dem catch two boys with 450,000 pills of tramadol and exol-5. NDLEA also seize 162kg skunk for Kogi and 128kg for Nasarawa. One mama of two, Oyonumoh Glory Effiong, wey dey distribute Loud for Lekki, Ajah, Ikoyi and VGC, don jam NDLEA hand too. Di agency also nab Jacob Ojugbele for Badagry with 55kg skunk, plus another man with 121 litres of skuchies. For Zamfara, dem arrest Abubakar Ibrahim with AK-47 and 1,746 rounds of ammo. NDLEA boss, Brig-Gen Buba Marwa (rtd), hail di officers for di hot operations and urge dem make dem continue di War Against Drug Abuse (WADA) campaign across schools, churches and communities.
Written by: News Editor 1
Lagos club owner arrested NDLEA drug bust 2025 NDLEA Lagos arrest
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025