National

NDLEA Gbab South African Woman With Heroin for Abuja Airport

todayJuly 12, 2026 10 14

Background
share close

Edited by Ebi Oboko

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don gbab one 38-year-old South African woman, Will Ann, for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja,say she carry 5.75 kilogrammes of heroin enter Nigeria.

NDLEA spokesman, Femi Babafemi, tok say operatives arrest di suspect during inward clearance of Qatar Airways Flight QR1433 from Doha after dem discover 14 big wraps of heroin wey she allegedly hide inside two suitcases.

Babafemi say di woman first deny say she get checked luggage, but later admit say di bags be her own after officers match di baggage tags with di claim tags wey dey attached to im passport.

According to NDLEA, di suspect claim say she travel from Cambodia through Doha to Abuja, as investigations into di alleged drug trafficking case still dey on.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds