Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
todayNovember 5, 2025 8 2
Regina Daniels’ elder brother, Sweezy, don raise alarm say dia younger brother, Samuel Daniels wey people sabi as Sammy West, don go missing after police arrest am for Lagos on Monday, November 3, before dem reportedly carry am go Abuja. According to reports, Sweezy drop message for Instagram accuse Senator Ned Nwoko of intimidation, talk say dis one no be ordinary arrest again. E yarn say Sammy never get lawyer, food or water since dem hold am, and nobody sabi where dem carry am go. E even claim say Ned talk am clear-clear say, “If Regina no come back house, Sammy no go ever comot.”
Meanwhile, Lagos State Police Command don talk say no be dem arrest Sammy West. According to dem, na officers wey come from Abuja with correct warrant arrest am. Dem explain say di arrest happen late for night, na why dem keep am small for Ogombo Police Division, before dem carry am travel out of Lagos for further investigation. Di mata don scatter social media as people dey drag Ned Nwoko for allegedly using power to intimidate Regina Daniels’ family.
Written by: News Editor 1
Ned Nwoko and Regina Daniels Ned Nwoko family issues Regina Daniels marriage update
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025