Sports

NFF Don Tell Clubs Wey Get Debt Make Dem Pay Sharp-Sharp Or Face Sanction!

todaySeptember 11, 2025 4

Background
share close

Naija Football Federation (NFF) Players Status and Arbitration Committee don send strong warning to NNL clubs wey still dey owe players, make dem clear their debts sharp-sharp or wahala go land. Di warning show face for one letter wey NNL Chief Operating Officer, Danlami Alanana, send give di clubs ahead of di 2025/26 football season wey wan start. The letter talk say:”We send una warm greetings from the Chairman, Board Members, Management and Staff of the Nigeria National League.”We dey under clear instruction from Nigeria Football Federation say any club wey still dey owe players, coaches or officials, and wey Players Status and Arbitration Committee don judge their matter, must pay up before dem go fit register for the 2025/2026 NNL season.”

The letter continue:”So, all the clubs wey this matter concern must show proof say dem don follow the NFF Players Status and Arbitration Committee decision before dem fit register for the league.” “As we thank una for una cooperation, make una collect our highest sporting regards with respect.”

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app