Lagos

Nigeria Start New TV Audience Measurement System for Lagos

todaySeptember 2, 2026 2

Background
share close

Nigeria don start new system to measure how people dey watch television for Lagos, using special People Meters wey go record di channels and programmes viewers dey watch.

Di initiative na joint project of NBC and ARCON, wey appoint First Media Entertainment Integrated Limited, FMEIL, in partnership with First Media Entertainment Integrated Limited to run di system and select panelists.

Di FMEIL/GARB chairman, Rotimi Pedro, say di project don dey work for about two years.

FMEIL/GARB Chief Operating Officer, Patrick Gomes, als oexplain wetin di Audience Measurement System dey all about and how di People Meters go collect di data.Gomes also say di People Meters free and trained installers go explain everything to selected households before installation.

And di project go cover 60,000 households across Naija, including about 7,000 homes for Lagos, wey go form part of di panel for di survey. Laslas na make advertising agency wey be media buyers know which TV program them go put their money.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds