OBODO NAIJA

Nigerian Army Bury Fallen General, Soldiers For Borno

todayApril 16, 2026 8

Background
share close

For Nigerian Army side, dem don bury Brigadier General Oseni Braimah, Captain Ismail and oda soldiers wey die for recent attack for Borno State.

Dem do di burial for Maimalari Cantonment Cemetery for Maiduguri with full military honour.

Na on April 9, fighters wey dem suspect say na Boko Haram and Islamic State West Africa Province attack soldiers for Benisheikh along Maiduguri-Damaturu road, kill di officers and men.

Big people like Babagana Zulum and Christopher Musa show face for di burial.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app