Di Nigeria Premier Football League (NPFL) don warn say any club wey im ball boys dey waste time during match go pay fine of ₦1 million. NPFL Chief Operating Officer, Davidson Owumi, drop dis tori for one circular wey dem send give clubs, say make dem reorient dia ball boys make dem dey promote fair play and respect di game. According to di statement, “Any team wey dey encourage or do dat kain thing go collect ₦1 million fine, as e dey against fair play and e dey spoil di image of di game.”
Owumi still yan say dat kain act na big misconduct under NPFL rules, and di league no go gree make anybody rubbish di integrity of football. He talk say dem dey serious about discipline, fairness, and professionalism for all match wey dem dey play. Di NPFL don use dis one warn clubs say dem no go look face if anybody try play rough game or use delay tactics to win.