By: Esther Ayoola
Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh, wia dis vex come from sef nor bodi sabi, say mama Remi never rob im head some time, omo jagaban, enter meeting for Abuja for di mata, change am 9ja govos and APC members say make dem support di idea of state police and local government autonomy.
Oga presido yanyanpu dis one for di 14th APC National Caucus meeting wey hold for Abuja on Thursday, say security dey alert, mhen go dey get beta bedmatics, bodi go sweet every body.
Tinubu yarn say governors suppose follow di Supreme Court ruling and make local government allocations go directly to di councils.