south west

Ogun State Extend Work Break And To Pay ₦10,000 Transport TFare For Workers

todayJuly 17, 2026 2

Background
share close

By: Esther Daniel

Ogun State Govo, Dapo Abiodun, don approve make di one-day-off-duty work palliative for eligible public and civil servants continue for di state.

Di govnor put dis one or news statement give news tatafos for Ogun state.

According to di govo Abiodun, di measures na to reduce di burden of transportation costs on workers and encourage dem to continue providing efficient and quality service to di people of Ogun State.

Di govnor still approve make gornment continue to pay qualified workers ₦10,000 monthly transport allowance for another three months, from July reach September 2026.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds