By: Esther Ayoola
Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, don react to di Federal High Court judgement wey say im nor fit contest for governorship again, say na distraction.
U sabi say, Aiyedatiwa take office 2024 afta im former boss Rotimi Akeredolu  kpai for office, before e con start another tenure on di 24th February 2025.
E tuk dis one as im dey do guest for tv sit don tuk on Thursday evening.
Aiyedatiwa say tuking about 2028 off-cycle governorship election nor be for now, cause work wey dem need finish.
E add say im mind na to fully deliver di one wey dey first, before any future tuks.