Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
One person don go Kpai afta trailers jam Jam demsleves for Otedola Bridge, Lagos, early mor mor on Friday, and say e cause serious traffic jam along Lagos–Ibadan Expressway.
According to di Lagos State Traffic management Agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, di main askident involve two heavy-duty trailers, one wey carry sand, the other one carry granite, ni jam demsleves igboaii.
Say Di driver of wey carry tipper of sand- trailer collect serious wunjury nor be small, later general hospital for Ikeja dem con konfamate im don kpai.
Traffic authorities dey warn motorists say di askident cause serious go slow and advise make dem find other routes.
Written by: News Author
lagos ibadan expressway accident Multiple vehicle crash Lagos Otedola Bridge crash Traffic jam Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025