By: Rilwan Agbomeji
Di UN children’s agency, UNICEF, on Tuesday report say over 100 pikin don die for Gaza since October ceasefire.
UNICEF spokesperson, James Elder, tell reporters for UN briefing by video link from Gaza say di dead include 60 boys and 40 girls, mainly from military attacks.
E explain say di attacks happen through air strikes, drone strikes, tank shelling, gunfire, and quadcopters, while small number na from war remnants wey explode.
E add say even though di bombings and shootings don reduce since di ceasefire, survival for Gaza still dey conditional because di violence never stop.