Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
One widow wey dey stay for oworonshoki don cry o say belle no sweet am di day wey lagos state govern come demolish her house wey she dey stay for more than 35years, she yarn dis mata for one siddon talk programme wey tori pipo cary take interview her on Monday.
she talk say government no notify dem, say na middle of di night na im government come notify dem say make dem pack dia kaya commot because na for early piepie dem go start to demolish di house.
Meanwhile, Justice and Empowerment Initiatives don accuse Lagos State Taskforce say dem dey ask Oworonshoki residents for ₦1 million to spare dia houses wey dem mark for demolition.
Di organisation’s Co-Executive Director, Megan Chapman, drop di bombshell Monday for one interview.
She tok say Taskforce officials allegedly dey tell people, bring ₦1 million make we no touch your house, but if you no fit pay, we go pull am down.
Up till now, Lagos State Taskforce never respond to di serious allegation.
Written by: News Editor 1
demolition scandal government abuse housing rights nigeria LAGOS NEWS naija corruption oworonshoki taskforce bribe
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025