Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Di Peoples Democratic Party don set up special legal team to challenge di result of Saturday Area Council election for Federal Capital Territory.
For statement wey im National Publicity Secretary Ini Ememobong sign, PDP say dem go challenge di alleged irregularities and di legal team go dey led by Shafi Bara’u, Esq.
According to Independent National Electoral Commission, candidates of All Progressives Congress win five out of six chairmanship seats, while PDP carry Gwagwalada.
Di election wey dem do to fill six chairmanship and 62 councillorship seats, say plenty pipo nor come out vote and report of vote-buying.
Written by: News Author
election result controversy Nigeria FCT Area Council polls INEC FCT election Nigeria political parties news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026