Lagos

Pipo Dey Sell Property For Chicken Change

todayOctober 30, 2025 3

Background
share close

Days afta Lagos State Government do midnight demolition for Tolu Alashe Street, Oworonshoki side, plenty people wey lose dia house still dey stranded for open place. Na mostly women and children dey suffer am, as dem no get shelter, food or any hope of where to go. Everywhere don turn to rubble, broken blocks, zinc, and house items scatter for ground where families dey live before. Plenty women dey cry as dem dey sell small-small tins to survive. One woman, Mrs Rebecca, mama of one, talk say she almost kill herself afta she lose her house, shop and savings. She pay N360,000 rent just two months ago before bulldozer come break everything. Now she dey sell her fan wey she buy N35,000 for just N1,000 to aboki scrap buyers just to chop and treat herself.

Another woman, Mrs Jumai, wey don live for di community for 10 years, talk say she and her children nearly die dat night. According to her, “Dem come around 11pm. We dey sleep when people begin shout say bulldozer don reach. We just carry small tins and run.” She talk say di bulldozer destroy her house, shop and even her pikin school. “We dey live for same place with di school, now everything don go. I no even sabi where I go start from again,” she cry. Aboki buyers full di area dey buy people property for chicken change as residents dey struggle to survive.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app